BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
How kasala make Senegal President Faye sack Prime Minister Sonko
Dis sack mean say President Bassirou Diomaye Faye dissolve di govment wey leader of Pastef bin dey lead.
US announce policy wey mandate foreigners to apply for green cards from dia home kontris
One new policy dey close one loophole wey don allow pipo to apply for green card, or permanent residency, while dem still dey di kontri.
Chinda, Hamzat, Alli, Adelabu - di big winners and losers for APC govnorship primaries
According to di 2027 election timetable wey di Independent National Electoral Commission bin release, di window for parties to hold dia primary election na between 23 April and 30 May, 2026.
Makinde suspend field trips for schools as teacher, victim of Oyo bandits attack get burial
Di funeral of di school teacher at Community High School, Esinella, hold for Ayegun Baptist Church for Ogbomosho on Friday.
Court nullify timelines of Inec timetable for 2027 election - wetin e mean for political stakeholders
Di trial judge rule say Inec no get power or authority to put deadlines for dia election timetable wey no be exactly as di Electoral Act tok am.
Tinubu hail NDLEA afta dem seize largest multi-billion naira meth for Nigeria, gbab Mexicans and Nigerians
Dis na di largest drug laboratory wey di anti-drug agency go discover for Nigeria.
Inside Makinde Executive Order wey go regulate local vigilantes, Sunday Igboho 'Ija Ekun'
Oyo State Govnor, Seyi Makinde ask leaders of dis different security outfits for di state make dem register wit di state govment formally.
Court find Air France and Airbus guilty of manslaughter ova 2009 plane crash
French court find di comapany guilty ova air disaster wey kill 228 pipo.
APC state assembly primaries: Barakat Odunuga-Bakare, Orode Uduaghan... Who be di big winners and losers?
For Lagos, Nolywood star turn politician Desmond Elliot don officially declare im withdrawal from di APC primaries afta Barakat Odunuga-Bakare win di party primaries.
Ginger Me
Special Tori
Six promises Nigerian politicians don fail to fulfil since 1999
Di five leaders wey rule di kontri make some big promises to di pipo wey dem don hear for a long time, but dem neva still fulfil dia promises or solve dis problems.
Canadian province Alberta go hold referendum on weda dem wan stay inside Canada or comot
Voters for western province go decide next October weda dem wan remain for Canada or move ahead wit di process of binding independence referendum.
Health authorities restart care response afta family members break into Ebola centre carry deadi bodi run for DR Congo
For anoda incident, DRC Congo cancel dia pre-World Cup training camp for Kinshasa, becos of di Ebola outbreak for di eastern part of di kontri.
President Tinubu appoint 39-year-old professor as Jamb registrar to replace Oloyede
Professor Segun Aina go replace Professor Is-haq Oloyede as di new registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb).
Who be ex-Cuba leader Raúl Castro wey US charge wit murder ova 1996 shooting down of two planes
Den, Castro wey now be 94 na head of di kontri armed forces and bin face international condemnation ova di crash.
Ghana authorities postpone evacuation of citizens from South Africa ova xenophobia afta number increase from 300 to 800
Ghana postpone di planned Thursday repatriation of citizens to allow pre-evacuation processes like screening and flight permits afta number rise from 300 to 800.
Fubara withdraw from Rivers state 2027 governorship election
For statement e sign by imsef, Govnor Fubara say e go support who ever go emerge as di candidate of di party.
Who be Pastor Dolapo Lawal wey Arsenal fans dey banter for social media
Di Pastor invite di club supporters to im church and e tok say di sermon na just joke and no be prophecy.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































